RE: Hive-Naija Weekend Engagement #34 - "Hobbies"

avatar
(Edited)

You are viewing a single comment's thread:

Yay!!! How far my filfo!

Who de breathe??? My hobby yakata for ground so tehh nothing fit carry am.

This gbedu wey I de see for Hive Nigerians so de make my blood high like Maradona.

Me na Balikis as ona take see am so and my first hobby just as @hopestylist talk na to de find trouble upandan like mosquito and rat. Naso i see am ooo so if you no say trouble na the real name wey dem for give you abeg tag me make we open people comboard yakata. Eyyy...

E no finish for there ooo, me like to sing and dance like se tomorrow no de. You see moonwalk wey Micheal Jackson dance, omo no too cast am, na me teach am. My other hobby na to talk tomorrow own down and to sleep because na better one.

Me also like food ehhh as per se life without food no de my dictionary but sapa na idiot sha, cos e wan thief my hobby but we de on God na😩😩.

My other hobby na to de read like mumu and to de write like pikin wey e mama give fiaaa fiaa for back as per se e steal meat for pot and to de watch film like witch.

E no end there ooo... Make ona wait make I tie my wrapper well call @fashtioluwa and @happyboy1 make dem con join gbedu.. @samostically you sef con join the wahala team and make you no forget to pin me for there sef. @mcyusuf



0
0
0.000
55 comments
avatar

See as I take dey smile as I dey read your comment, e be like say you na correct wafi pikin oo, aba na, shoo, you finish work for the pigin English level normal normal.

Your face show, your shoe shine my dear.

You get the hobbies them buku, Carry on my dear.

I happy say you come fit join the gbedu, made we dey push am dey go tweletwele.

0
0
0.000
avatar

Naso oo make we de push am go like wheelbarrow.. How fa?.. Na Friday we de so make we scatter floor break bottle for ground.

0
0
0.000
avatar

Hahaha, abeg oo, no vawulence oo 🏃‍♀️🏃‍♀️🏃‍♀️🏃‍♀️🏃‍♀️.

0
0
0.000
avatar

Na peace nation you de rule? Abah na waoo. No lele sha

0
0
0.000
avatar

Yes oo, lol.

Abeg make you calm down small 😂😂, I nor get power oo 😂😂.

0
0
0.000
avatar

Guyyy😂😂😂 Abi na girlllll😂😂

This your own hobby was created before the creation of Adam and eve o.. Aha

0
0
0.000
avatar

😂😂😂 you make me laugh yakata full ground like pig wey just born. Abeg go engage others too.

0
0
0.000
avatar

I know your hobbies even before you highlighted them 🤣🤣😂🤣. Looking for trouble should be number one and it's cute.

My efiwe... I know say you no dey ever carry last.. shey that wind don blow you? I still dey expect that wotowoto with the wind o

0
0
0.000
avatar

Naso my man, trouble na the ogbonge number 1 life ingredient for yia.
Who no like trouble never sabi better thing.
Chaiii you too de carry me de flow for up like say I be Herbert Macaulay. Anyways I gather de here like iroko tree.. As per the wotowoto suntin, fire the fire well well cos I de kanpe with the breeze.

0
0
0.000
avatar

🤣🤣🤣😂😂😂🤣🤣😂you are a whole new vibe.

0
0
0.000
avatar

I de try my oga, you na boss na.. Maka con collect small ingredient for moimoi?

0
0
0.000
avatar

I know your hobbies even before you highlighted them 🤣🤣😂🤣. Looking for trouble should be number one and it's cute.

My efiwe... I know say you no dey ever carry last.. shey that wind don blow you? I still dey expect that wotowoto with the wind o

0
0
0.000
avatar

Omo! Balikis wetin be this? Come see as i dey laugh for here. I go like see your moonwalk o, i no say even Micheal Jan-sin go dey envy you wherever him dey.

0
0
0.000
avatar

Hehe, he go envy me so teh go one come back.. Because my moonwalk no be ordinary waka..

0
0
0.000
avatar

Na now I know say we get serious issue for this community😂. How person hobby go be to dey find people trouble like mosquito? On top of that, sleeping dey among. My people una too much. Kudos Ma'am. The sky is your starting point😂😂💔.

As you just begin dey blast for us pidgin like this, I just sabi say your hobby na trouble. It's well.

0
0
0.000
avatar

Wellycome padi e, you see that trouble wey you see so de sweet like ogbonge hot cro-co-di-leh soup.. Sleep na better thing wey de add ingredient to person body. Just epp me leave am like that..

0
0
0.000
avatar
(Edited)

Omo my pigin no go like this oh, I no sabi yarn pigin like this, ahhh this one full book yaapa, I give you 💯💯💯👈 ahhhh you na boss for here oh...

Abeg you no grow up for here abi??? Your pigin dope die💯💯💯✅✅❤️❤️❤️

0
0
0.000
avatar

Padi e, me just de learn to yarn am oo I still be embryo for where others de..
Tanku for you the gbedu wey you bring come, you head de horn like lantern.

0
0
0.000
avatar

wahala be like bicycle o, se as you dey follow me dey yarn all this big big pigin omo you get level oh...

0
0
0.000
avatar

My padi!! No be so o, I just de like Dele, you na confirm guy.. Chop small noku

0
0
0.000
avatar

Better go and learn am

You wet be all rounder 🤣🤣🤣🤣🏃🏃🏃

0
0
0.000
avatar

All rounder bawo🏃🏃🏃🏃

0
0
0.000
avatar

Lmaooooo… I totally love your use of pidgin ohh. As I was reading this I was like ah, there’s levels to pidgin English oh 😂😂 wahala 🤣

Me also like food ehhh as per se life without food no de my dictionary but sapa na idiot sha, cos e wan thief my hobby but we de on God na😩😩.

Sapa na really idiot.. we Dey the same boat my dear. Sapa wan dull my shine 😭😂

0
0
0.000
avatar

Tanku oo sweety pepper olele.. Me like as you con follow me yarn with this gbedu.

No mind Sapa oo the idiot be de form okonga but e no know se craze de ground like sand.

0
0
0.000
avatar

🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣

This babe ooo
Don't succeed in bursting my tommy with laughter ....okay association of trouble makers...oya make una gather here...

@hopestylist how did I miss this entry 🤩🤩🤩, why u no tell me say our neighbour for trouble make dey here🤣🤣🤣

Westin be that abbreviation wey formed sef.....Gentle trouble makers something .....hahahaha

0
0
0.000
avatar

As in ehn, this one nor be gentle one oo, this one na area scatter oo, we dey learn for where she dey oo 🤣🤣🤣🤣🤣.

Oma, I nor tell you because this one fit make trouble with us too oo, I don run commot oo 🤣🏃‍♀️🏃‍♀️🏃‍♀️, I nor do again oo 😂😂😅😅😁😁.

0
0
0.000
avatar

🤣🤣🤣🤣🤣
Better come back and finish what you started..lolz

0
0
0.000
avatar

Hahaha, no oo, I've already reach south Africa oo 😂😂🤣🤣😁😁😁.

0
0
0.000
avatar

Waka come back olele make we renovate everywhere with letter T

0
0
0.000
avatar

No oo, them don block borders oo 😂😂😂.

0
0
0.000
avatar

Fly am pass abi show them white.

0
0
0.000
avatar

Hahaha, I nor Sabi fly oo 😁😁😅

0
0
0.000
avatar

Crawl na😃😃

0
0
0.000
avatar

I nor Sabi swim oo, river full the road back oo 😂😂.

0
0
0.000
avatar

Believe jare..walk on the water

0
0
0.000
avatar

Correct babe.. You head dey there, see ehnn..call am as you sabi as far se trouble go de, no lele..

0
0
0.000